Fitness

Exercise in old age: ‘I be 73 years old and like to carry weight’ – BBC News Pidgin

Published

on

Dem no support media player for your device

Wetin we call dis Video, Exercise in old age: 73 years old grandma wey like to carry weight

‘I be 73 years old and like to carry weight’

‘’I no get any plan to retire from exercising‘- Dat na wetin Rosalind Umar tok wen BBC Pidgin ask her if she go stop to do exercise.

Advertisement

Madam Umar wey be 73 year old grandma don dey do exercise for more dan 10 years now.

She say she no go stop becos exercising get plenty benefit.

Grandma Rosalind dey exercise three times a week wit her husband Abdultalib Umar and dia physical trainer Michael for dia house for Lagos Nigeria.

Dia workout routine include weightlifting, boxing and strength training exercise dem.

”I like to carry weight, I like to carry weight well-well”. Rosalind Umar add put

Advertisement

Na knee pain make Grandma Rosalind start her fitness journey afta her doctor advise her to lose weight.

Since she start dis exercise mata many years ago she neva look back.

Video by Fiona Equere and Adekola Olawale

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

Trending

Exit mobile version